Friday 1 November 2013

How to BECOME a WIFE MATERIAL

Ok, here's a bit of suggestions I put up on how to BEcome a WIFE MATERIAL...I aint saying everything goes but trust me, following this list can increase you from one yard to around ten yards original wife material. Please see a couple of tips below:

a) BEAUTY: Some people say "beauty is in the eye of the beholder" but my sista, nor send dis talk o. I have seen so-called beautiful babes remain single until dem old bcos dem allow d beauty enta dia eye. Sis, pls understand d true meaning of beauty. Beauty mean a good heart with a clean body, SHIKENA! Some babes wan marry, yet dem wicked die (may Oluwa help). U wan marry yet u still dey allow d bush 4 ur armpit & nose dey long? U wan marry yet u nor dey use roll-on & if u pass by, pipu go dey cover nose? Or pipu nor dey gree give u lift 4 inside AC car bcos of ur body odour? Sis, even prayers cannot deliver u 4rm dirtiness. God nor dey like dirty pipu. So go & baff, buy roll-on, cut d bush wey dey under ur armpit & inside ur nostrils, den knee down fire prayer give GOD. HE is able!

b) BE APPROACHABLE: My sister, u dey pray make God give u husband yet anybodi wey approach u, u go jus dey rake. Dis one implies dat u're not well. If u dey find husband, u suppose dey put on smile 4 ur face. Always be ready to help a lost brother (wey dey find street) on the road. GOD go deliver u 4rm gbomo-gbomo pipu!

c) DON'T BE MATERIALISTIC, BE REALISTIC instead:  Once you get materialistic, you become like every other possession a man has which can be used and dumped. Be on the realistic angle of life, take your eyes of material things (cars, money, spendings, shopping) or OJU KOKORO LO MA KPA YE. You'll end up being used and DUMPED, den u go come begin dey talk say "guys are wicked". If d guy nor get car or house or money, comot ur eye 4rm dat one. Look deep inside! Does he have a PLAN? Is he on the right path to achieving his PLAN? How is his personal life? Is he lazy and totally dependent on a fellow man and not on GOD? What is he currently doing now to get to where he wants to get to? Ask Gods to show u things o! Still remember some people are living on borrowed resources, some are doing negative things to drive posh cars and live luxury lives. Be warned or else Oyo lo wa o!

d) GO AND LEARN HOW TO DRESS: My sista, u cannot be looking for a sharp spirit-filled guy and yet u go dey dress like chosen pipu. Please combine good colors, even if u nor get moni Yaba railway dey dia. N5k fit arrange u die. Dont be shy, just go collect one or two Okrika, nobody go know my dear. Buy, pray over am, wash am, use starch arrange am well. Den come start to dey do correct color combo. Our God is a colorfully radiant God.

e) COOKING NKO?: My sistas, guys don tire 2 dey chop Portie wey dem cook (i nor follow sha cos me I be correct chef, I can COOK like dat mate), so go and learn how to cook. Atleast, u suppose fit arrange atleast 5local soups including Oha, Gbegiri, Eforiro, Edikaikong & most importantly Eguisi soup. Around 75% of the male population 4 naija dey chop Eguisi soup. Den atleast, learn stew, fried rice, jellof rice, Yam & beans and some small chop things. Guys nor get wahala but once hunger dey beat dem & food nor dey, na serious wahala. If u nor sabi cook, just knw say d guy wen una marry, d guy go dey look somewhere to satisfy hin belle.

f) DOMESTICATION NKO?: Sistas, atleast if not anything, u suppose sabi how 2 keep d house clean na without d help of a househelp to start with. Guys hate dirty homes even though they demselves could be dirty sha. 4 those wey nor sabi, please go & learn how to wash plates, toilet, clothes etc (4get ur nails o). Either u keep your house clean and bone your nails or you keep your nails and forget your home.

g) LEARN A TRADE: Great men love to see their women do great things. So learn a trade and start getting at it, executing (no matter how small; buns making, beads, trading, whatever). Makes you his superwoman. U nor say guys sabi boast about their wives ("oh, my wife does beads", "Oh, my wife sells cars", "Oh, my wife trades BLA BLA BLA")

h) LEARN TO TAKE CARE OF THINGS: Especially your man's things. Once you take care of your husband's things, he'll take care of yours.

i) BE TRUE TO YOURSELF: This is the most important of all. Nobody fit tell u d kain truth wey u go tell ursef. Sit down and ask yourself certain questions. Carryout a self examination of your past, present and future activities. Are you progressing or retrogressing? Are you an Akpiri Ogologo (LONGER THROAT)? Cut your clothe according to your cloth! Don't borrow to live large as you can never be larger than you creditor! Check yourself before you wreck yourself!


Ok, presently, I am completely exhausted for now (if una get any other one, make una add). Finally I pity those babes wey go dey die for Celebs and entertainers. My sista, wake up! Those pipu nor send u, if u reach dia side go fall, dem go jus sleep wit u, do like say dem nor know u 4 morning. It's totally disgusting when I see matured women who should have embraced reality saying "Oh, I just love 2face or Psquare or Wizkid"! Crap! Wake up and smell the coffee! Snap back to reality...Don't bone Obinna bcos u wan go see Psquare for Oriental hotel o! Small Obinna of today may be a top shot tomorrow!

Enjoy dis one until I get inspiration to drop something new! Have a great month ahead!

1 comment:

  1. b) is very important my brother. very. Yeah and personally e) as well... If a guy says he doesn't mind a girl who doesn't cook, me thinks he's lying.
    I think you should write your view on the other side though... How to BEcome a Husband Material.

    ... the man who gives out his favourite wrist watch is a great man...

    ReplyDelete